CRIES OF A BROKE DUDE By Stephen

Baby girl na poor I poor I no kill Person.
Na broke I broke I no get Leprosy.
House wen dem dey use door enter
Dem fit still use window enter.
You say you want gown of 50k
I say gown of 3k wen dem wear with style, swag and yanga na also 50k.
Maggi fit be choco-milo if you package am different.
Na broke I broke no be craw craw I get
You say you want make I carry you go Fast food.
Say you want just Rice, Chicken and coleslaw wen you go wash down with big fruit juice.
And takeaway: 5 meat pie, three burger.
No problem baby.
After all if I dey wash you go dey rinse.
Na broke I broke no be sense I no get.
You say you want Chinese.
I buy Drunken Master by Jackie Chan
And Best of Jet Li DVD come house.
You vex comot.
No be Chinese?
Na broke I broke I no kill person
You say whether na bright future you go chop?
I say you need to enter my dream for night see where I dey chop am – my future.
Where I dey spend lau lau,
where I dey declare drink
dey declare things
Dey declare even public holiday sef.
Baby girl Na broke I broke.
Na now I broke the broke.
Tomorrow e go better I know. But you no wan know.
You no wan hear story of how bird born five fifteen come die.
But as you tok slippers get size.
And I still dey wear size 5
Say you no fit stay again.
No wahala baby.
Dat one dey.
I still young so I still dey grow.
Just make e no surprise you when my leg go grow.
I no go wan wear slippers.
Cos na timberland go be my size.
Na broke I broke….
Na Love I love you
Stay with me
na beg I dey beg.
E go be. ✌✌


Written by Stephen....

Comments

Popular posts from this blog

SCHOOL SWEET BUT EXAMS...... - Uncle Stephen

CAMPUS DILEMMA 2

CALiSTUS By Thywill